"My step mother Poured acid on me because I wouldn't bed her"-34 yrs old man that looks like an Ojuju later finds love as he tells his bitter story to the world ( photos)

  



   My wife, Mrs Romoke Elizabeth Dada tok

say she decide to marry her husband

sake of say she love am wit all her heart

and na man of God.




     She say wen she cari Abiodun go meet

her parents, dem insult am sake of her

choice of man. Di couple get four children - three girls and one boy.

  "Dem say me wey fine like dis wan marry

dis kind pesin. I say make dem leave

me," Mrs Dada tok.

     She say she dey encourage her husband

make im no tink am if pipo dey call am

names outside sake of im condition.

Mrs Romoke Elizabeth Dada tok say she

no dey shame to go out wit her husband

and add say di man na pesin wey get

patience.

    "I see am as man of God and pesin wey

go give me peace of mind if I marry am.

And I tank God say I get peace of mind

wen I marry am. Na beta pesin," she tok.

She say na evri day her husband dey

make am happy

 "Wen I dey one year and six months, my

cousin pour me acid. Im bin dey stay wit

us. Wetin happun be say, im and my

mama get misunderstanding, im kon tell

my mama saye go let am know di kind

pesin wey im be."

Dis na wetin Abiodun David Dada tell

BBC Pidgin as im and im wife share tori

of dia life.

Abiodun tok say wen im cousin come

back home from wia im go, im cari

outside come back and im parents no

know.

"Im just ask my mama wia l dey, my

mama tell am say I dey inside dey sleep,

im just go to di bedroom, cari me for wia

I dey sleep, take me to backyard and

pour di acid for my head and also open

my mouth pour di acid. Afta dis, e cari

me go inside and jump fence to run.

    My mama arrest am but ehn family members come dey beg.she later free am but I go leave with this scar for the rest of my life.

Comments

Popular posts from this blog

"I made sure,you didn’t miss my wedding day” – Bride visits her father’s grave on wedding day to give him flowers in emotional( video)

Nigerian Singer Ruger Reveals The Secret Why He Wears an Eyepatch(photos)

Nigerian man mourns sister-in-law who died from pregnancy